Posts

Image
           Minister of labour plus productivity Oga James Ocholi don die The oga Minister ontop Labour and Productivity, oga James Ocholi die yesterday for accident when dem dey travel go kaduna from Abuja. According to tori dem say the motor (SUV) wey dem carry tire burst and dat one come make dia motor tumble sootay Oga Ocholi and him pikin Joshua come die immediately. But pipu wey dey around carry hum wife madam Blessing go Doka govt hospitu wey dey kaduna where madam too come die around 4 0, clock yesterday afternoon. Make chineke Godu let dia soul rest for peace AMEN.

MOTHERS' DAY

Image
My pipu make all of us join hands to carry gboosa give all the Maale dem for obodo world gabadaya because today na MOTHERS DAY and we need to celebration maaales dem.

Walking from glory to glory

Image

My Slideshow in IB CITY

Image

Obodo Taraba talk talk man don kpai

Image
My pipu una know say holy book talk am say every thing for dis we world get him time. Time dey for person to enta dis world and time dey wen person go delete comot from dis world. Water dey rush for my eye as I carry chalk dey write dis tori. The tori wey reach our ear dis early mormor be say the ogbonge talk talk man for obodo Taraba  wey oyibo dey call speaker of the Taraba state house of assembly oga Haruna Tsokwa don kpai. We hear say him jos fall for ground and dem come rush am go hospital but him no make am at all. Other tori wey we hear be say dis talk talk man follow for pipu wey no gree make dia govano Danbaba Suntai wey go obodo oyibo go treat himself come back come Sidon for chair as govano again and say e get one time wey some jaguda boyz attack d talk talk man, kill him boy wey dey follow am waka but dem no see oga  Haruna  catch dat time. We even hear say oga Haruna Tsokwa  get heart problem before. Chaiiii, anyway make him s...

Our own Jim Iyke go soon Marry oooooo

Image
Contri pipu aw una dey? Una know say e don tay wey we dey hear say our own naija pikin, actor and bigga boy Jim Iyke dey waka with one Ghana yellow erima wey her name be Nadia Buhari and say Jimmy don ready to carry the bebe climb ontop altar go do "yes I do".Since we hear am, we jos Sidon dey look anya anya and dey pray make the day reach quick quick.  But as the amebo come dey waka too much sootay even fowl dem wey dey street dey tell all the birds dem the mata, na him our guy vex come nack am for him twitwi say, yes na true say him carry the otepu come naija and him family pipu gbadun the okpariso but say him no dey rush the marry me mata.  Jimmy say him and the Ghana yellow pawpaw talk about marry, say him sef don reach level wey marry dey sweet him mind but say him and Nadia Buhari no wan rush but dem dey take am sofri sofri. Jimmy boy I like your style abeggii. no rush at all bcos na jejeje person dey take lick soup wey hot.

Tubaba pikin go soon land

Image
Dikeh, Dis na the fotos wey dem take for madam Tubaba Anniemacaulay house when she gada bebes dem to join her do dat tin wey oyibo dey kol baby shower