Things wey go helep us get long life

healthy foods for you

my pipu many disease just dey waka waka up and down inside dis we world today. But i want make una know say the reason why pipu dey sick no be sake of say dem wan sick, but na bcos many of us no dey take kia of ourself. some of us go work like jaki from morning till night but we no go chop betta food. After small time if we body don tire come vex dey give us wahala, dat time na him some pipu go run go dey buy merecine for chemist shop, for pipu wey dey sell for inside motor or even for aboki pipu hand sef. Dis kind thing no good at all. Abeg my pipu i wan make una know say betta food and rest dey helep us stay kampe and our body go strong kakaraka like zuma rock. oya make una follow me make we talk about foods wey fit make our body strong and our life long well well.

Comments

Popular posts from this blog

STILL LOADING.

BACK ON WHAT I LIKE DOING