Tubaba don score again
My contri pipu, dem don talk am say anybody wey baba God bless nobody fit look am bad eye. My body jos dey sweet me sake of say our own naija pikin, the only guy wey God bless with plenty plenty things sootay any woman wey him follow play ball must catch the goal, don do the thing again. This our guy no dey slack at all, na real goal shooter him be and I wan advise all obodo naija bebes to comot eye for him body unless dem wan catch the goal wey him dey shoot anytime wey him play ball. Abeg make una clap for our own Tuface Idibia alias Tubaba.
Tubaba don play ball with him fyn bebe Anniemacaulay immediately after igbeyawo, come sentence her go prison for nine months. My pipu very very soon all of us go gada for Tubaba house to do naming ceremony bcos tori wey fly enta our ear be say the wife gada oda ogbonge bebes for dia house today and dem come do dat thing wey oyibo dey call baby shower. That is to say dem dey prepare to welcome the new born baby wey our guy hide inside Annie belle.
The ogbonge bebes wey go do the baby shower for Tubaba house na Tiwa Savage, Tonto Dikeh and many odas. Hhhhhhhmmm Tubaba we don drink purge merecine ooo, we all go dey for the naming ooo dat is if you no carry the party go indian
Comments
Post a Comment