Posts

Showing posts from September 22, 2013
Image
  my betta betta contri pipu, aw una dey, abegi I wan use this my slate and chalk dey teach una tinz wey go make life betta for me and una, aw we go take live our life so dat our body go dey alwaz strong kakaraka like zuma rock and also aw we go take dey do ontop our lovilovi life so dat happiness and jolificate go dey follow us up and down for dis we world wey we come. Before me and una go start to dey waka dis joni of teacher and schooldent, I go like tell una about myself. my name na SISINENE, pipu dey kol me SISIWAZOBIA. I be one of the talkatives for WAZOBIAFM wey dey inside obodo kano. abegiii ooo the one wey I talk don do. if you wan do plenty amebo about SISINENE, make you see me for inside kamera.

Things wey go helep us get long life

Image
healthy foods for you my pipu many disease just dey waka waka up and down inside dis we world today. But i want make una know say the reason why pipu dey sick no be sake of say dem wan sick, but na bcos many of us no dey take kia of ourself. some of us go work like jaki from morning till night but we no go chop betta food. After small time if we body don tire come vex dey give us wahala, dat time na him some pipu go run go dey buy merecine for chemist shop, for pipu wey dey sell for inside motor or even for aboki pipu hand sef. Dis kind thing no good at all. Abeg my pipu i wan make una know say betta food and rest dey helep us stay kampe and our body go strong kakaraka like zuma rock. oya make una follow me make we talk about foods wey fit make our body strong and our life long well well.