Posts

Showing posts from March 20, 2016

NOMORELOSS BURY DATE DON COME OUT

Image
The family of we own naija singer, Nomoreloss’ wey just die afta small sickness don announcement him bury date. Nomoreloss, wey him real name na Olumiyiwa Osinuga service of Songs go shele Thursday, March 31, 2016 and dem go bury am on April 1st. He die come leave him wife and daughter. Make him soul rest inside peace!

FROM MARRIAGE MATA TO DEATH.

Image
Girls una nid to learn from dis...talkingE don become serious kasala now to dey travel long journey all in the name of say you wan go see or meet boyfriend/friend wey you no sabi well well. Dis babe wey una see her pishure here meet one man for facebook wey tell her about marriage. She sef come think say na true, she come travel to Minna inside Niger state to go see the guy, only for her to turn to dead body after the man cut her head comot from her body. Babes oooooo, make una dey careful abeg....

NAIJA SOLDIERS UNA WELDONE.

Image
Una weldone oooo, Naija soldiers for all una gud work. Dis na pishure of how naija soldiers dem take clear Baale village comot from Boko Haram pipu hand, save one hundred and eighty pipu and kill two Boko Haram pipu.

JOHN MIKEL OBI, NEW SUPER EAGLES CAPTAIN

Image
 Tori wey just fly enta our ear now be say conference dey go on for Kaduna and e be like say na John Obi Mikel, na him go be the new captain of Super Eagles. Anyway we go bring una the full tori when we finally gada am. See wetin Ahmed Musa yarn. Ahmed Musa : I want to announce now that from today, John Obi Mikel is our new captain.

RITA DOMINIC WITH WOMEN WEY DEY FIGHT FOR GENDER EQUALITY.

Image
We own Nollywood actress, Rita Dominic, join hand with women dem to show her support ontop the one wey oyibo pipu dey call Gender Equality Bill, She join oda naija woman dem for inside peaceful protest wey dem do on March 23, 2016, inside Ikeja, Lagos. Dis group been announce for facebook say anybody wey wan join make dem show face only for Rita to show face and join dem do the protest. Dis na the pishure of the rally:

DIS WE WORLD NA WAYA.

Image
I know sabi wetin i go kol dis one, but according to informate wey we hear, dem say dis man wey get bobby na for inside crusade dem see am where man of God pray for am to do the one wey oyibo pipu dey call deliverance. Dis world na waya ooo...

MAN WEY DEM KILL FOR PH.

Image
Some pipu just kill the man wey get dis motor now now for front of Oando filing station wey dey Rumuomas inside pohracot PH.

MAI-GUARD RAPE 8YRS OLD GIRL

Image
Dis world na wah. Dis small girl of eight years old wey her pishure appear for here, na one agbaya man wey be mai-guard na him rape the girl just because e give am ten naira to take buy biscuit. According to the tori, dem say the man dey look blue film when the girl enta him room. E come tell the man to give her ten naira for biscuit, only for the man to give her and tell her to remove her cloth. The girl no gree na hin the man come do am by fire by force  and dis pikin na nebo her mama and papa be to the agbaya oo.. Make God dey helep us protection we pikins dem from some pipu wey call diasef man.

TUBABA AND HIM WIFE JOLLIMENT.

Image
Our own Tubaba and him wife, Annie Idibia dey gbadun diasef as dem dey celebration dia three years marriage Anniversary. Tubaba and Annie, make una carry waka jooorrr...

NAIJA ARMY INSIDE SAMBISA FOREST.

Image
Naija Army dem inside Sambisa forest dey jolli jolli. Dis na dia pishure.

NAIRA EXCHANGE RATE TODAY.

Image
 Dis na Naira Exchange Rates Today 24/3/2016.

FULANI WAHALA FOR BENUE.

Image
My pipu, abeg na when dis Fulani mai namas dem go stop all dis kill kill wey dem dey kill human being like dem? We nid to dey pray for dis we contri oooo. Dis na pishure of old man wey Fulani pipu kill for Benue. Him pikin enta bush carry him papa to go bury am. OOO God helep naija!!!

PETROL OGAS DEM FOR ASO VILLA

Image
Dis na pishure of officials dem for National Union Of Petroleum & Natural Gas Workers NUPENG and Petroleum and Natural Gas Senior Staff Association of Nigeria, PENGASSAN, when dem go visit we naija presido, Baba Muhammadu Buhari to discussion and rub mind with am about the fuel kasala wey dey shele inside naija....

NAIJA SENATE PRESIDO, BUKOLA SARAKI.

Image
Dis na the pishure of we naija senate presido as e dey sign the 2016 naija budget. Senate presido share dis pishure come talku say: "I just affixed my signature on @NGRSenate's approval of S.B. 212: The 2016 Appropriation Bill which passed today."

TUBABA YOU TOO MUCH, MAN WEY SABI.

Image
 Hahahahahah!!!! my pipu Tubaba no go kill me with laf. Make una see wetin him write as him and him wife dey celebration three years for inside dia marriage. Na wetin him write be dis:  “Make una help me thank this babe as she gree 2 manage me o. May the Almighty continue 2 guide us. Happy wedding ANNIEversary”  

TONTO DIKEH I HAPPY FOR YOU OOOO.

Image
Tonto Dikeh na very happy woman. The actress and new mummy share dis pishure where she, her mother -inlaw and aunt-inlaw (left) dey togeda and she come write say: WCW goes to these two wonderful,Beautiful women in my life..my Radiant humble,beautiful and magnificent mother Inlaw(Right) and my Heart of gold,Fashionista,Gorgeous Aunty Inlaw @niketojo..In love with them and how they treat me,Am so grateful to God I have this love from my Inlaw..Very rare find••The Love they have for my husband and Son is overwhelming••God designed my life and I can only be grateful.  

ALAMIEYESEIGHA GO FINALLY ENTA GROUND ON SATURDAY

Image
The first civilian Governor of Bayelsa state, Chief DSP Alamieyeseigha go finally enta ground ontop bury levels on Saturday, 26th March 2016 for him village wey dey Amasoma inside Bayelsa State. Alamieyeseigha die on 10th October 2015 for age of 63. Alamieyeseigha die for University of Port Harcourt Teaching Hospital afta him don dey inside wetin oyibo pipu dey call coma for days.

ABIA STATE CORPER DEY CHANGE CHILDREN LIFE

Image
Dis na pishure of how one corper for Abia state dey change the life of childrens dem for the state.