Posts

Showing posts from March 27, 2016

DIS NA LOVE ABI NA FOOLISH?

Image
Dis young man wey him pishure dey here, go kill himsef sake of say him mama and papa no gree say make him marry somebodi wey him love. Sake of dat him come go jump inside well wey dey Jekandafari area of Gombe State.  

OLD SKOOL BAIDAY TINZ

Image
If you follow go dis kind old skool baiday and you neva marry, abeg go check ursef somtin dey wrong...

GOODBYE MAMA MAGARET UMAHI

Image
Dis na pishures from the bury ceremony of Gorvernor Dave Umahi mama, Madam Magaret Umahi.... Thanks for being there for me, Gov Dave Umahi seems to be saying to Govs Okorocha and Ikpeazu Gov Rochas Okorocha and other Gov Horse carriage Aides of the Imo State Governor: From left to right- CPS Sam Onwuemeodo, Barr Simeon Iwunze (White Man), Information Commissioner Engr Chidi Ibeh, Lands Commissioner Law Eburuoh, SA ICT, Ik Ogbonna, Barr Emma Ibediro Commissioner for Community Government and Finance Commissioner Obinna Mbata. Venue Former President Olusegun Obasanjo and Govs at the Burial Venue Gov Okorocha acknowledging cheers from the crowd Former President Olusegun Obasanjo and Govs at the Burial Gov Okorocha with Enugu State Gov and Arthur Eze Olisa Metuh and Enugu State Gov exchanging pleasantries with Owelle Rochas Okorocha

FIRE BURN ON THURSDAY FOR GWARZO MARKET

Image
Another fire kasala shele for  mid-night of Thursday for Gwarzo market inside  Gwarzo Local Government Area of Kano State, and e spoil plenty plenty things wey reach millions of naira..

Flavour- DANCE (Official Video). Dis na Flavour Dance new video

Image

TOKE MAKINWA BUERIFUL BEBE

Image
Dis na pishure of wetin Toke Makinwa wear go Africa Magic event on April 1st evening...      

OMAWUNMI AKINNIFESI APRIL FOOL

Image
The 2005 before before MBGN beauty queen, Omawunmi Akinnifesi do sharp one yesterday as she do April fool for naija pipu by talking say she don hook one man. Anyway sha she rili fool some pipu but she later come out talku say na April fool.... Dis na wetin she write #Aprilfool I couldn't help it. Too bad this photo may not get as many likes as the prank photo. Goes to show you gossip gist spreads faster than the truth But don't worry guys. Very soon. Thank you for the calls, texts and DMs . To all my lovely bloggers. Sorry for inconvenience" Personally, I won't play such a prank if I'm in a relationship,because the guy may feel I''m indirectly asking him to propose..

CONGRATULOBIA TO CSP ABBA KYARI

Image
Presido Muhammadu Buhari on Friday, March 31, carry award give one oga police, CSP Abba Kyari wey be the police officer wey dey behind the group wey lead the Special Intelligence Response Team wey save the 3 school girls wey gbomogbomo dem carry waka inside Ikorodu on March 6th. Na dis same CSP Kyari na him lead the team wey save we before before Minister of money Mama, Madam Ngozi Okonjo Iweala from the hand of gbomo gbomo wey carry mama waka for Delta State inside year 2012. Presido nack am award wey oyibo dey call Presidential Award for Courage....

BUHARI AND ODA LIDAS DEM

Image
This na pishure of we Naija presido, Muhammadu Buhari, Obama for America and oda lidas dem for  yesterday meeting inside Washington DC...

LASGIDI FOR REAL.

Image
Eko oni baaje!!! Obaje ti. Dis na pishure of Lasgidi. Small London.

WOMAN ARMY ROBBERS DEM FOR RIVERS STATE

Image
Dis na pishure of Naija dangerous woman army robbers plus including gbomo gbomo group dem for Rivers State. Dia names na Queen Eze,Osarachi Onyewu, plus including Queen Godspower wey be the leaders  for the dangerous group. Now police don catch dem and dey ready to carry dem go court.

AY WIFE, MABEL MAKUN

Image
Comedian Ay Wife, Mabel Makun, too make sense for inside dis her pishure wey she snap to take prepare for her baiday wey go soon shele. Mabel Makun you make brain...

CONGRATULOBIA TO OUR OWN CLARION CHUKWURAH

Image
We own Nollywood actress, Clarion Chukwurah, collect award for Danny Glover Humanitarian for New York on  March 28th. She show face for the award ceremony togeda with her new husband, Anthony Boyd.

I GO LOVE OOOOO.

Image
Tubaba and wife una too much jooorrr!!!! I go love ooooo. Dis na pishure of Tubaba and Annie Idibia, as dey dem love up ontop dia numba three years inside marriage.