Posts

Showing posts from March 6, 2016

OONI SMALL WIFE CONGRATULOBIA

Image
The Ooni of Ife don pay him new wife money for head wey oyibo dey call bride's dowry today. We hear say na N25 na him pay. Dis na pishures of the new wife Wuraola. The Ooni pay the bride price but him no dey dia.

FUNKE DON BE FACE OF IROKO TV (CONGRATULOBIA SISTA)

Image
 After Funke Akindele collect awardu for AMVCA 2016 wey just finish, na so goodluck just dey follow am up and down since then sootay on wednesday IrokoWorld TV headquarters dem for Ikeja come call am say make e come be the face ontop dia produce the one wey oyibo pipu dey call BRAND AMBASSADOR.

FELIX IBRU DON DIE.

Image
The before before gorvernor of Delta state, Felix Ibru don die. The man die for age 80yrs after small sickness worri am. Make God Almighty give am rest of mind AMEN.

BEFORE BEFORE PISHURE OF TOOKE MAKINWA

Image
Walahi i no beliv my eye when i see dis pishure. The pishure make we know say tru tru wetin bible talk say time dey for evritin inside dis we world na rili tru e be. Dis na pishure of wen Toke Makinwa neva get anytin and the pishure of wen she don turn celibriti. Kaiiiiii no be joke oooo God can turn anybody around anytime. Baba God abeg pick my kol oooo. This na Toke wen she neva sabi aw far This na Toke now. Hmmm no be small change oooo

MAN KILL HIM BABE COS OF GONORIA.

Image
One 31yrs old man wey him name be Ekanem Ikot don kill him 27yrs old babe Edet Owei from Delta state sake of say the babe carry gonoria give him the guy. According to tori, dem say two of dem don dey do lovi lovi for like six months now and the guy come invite the babe go hotel where e kill am and vamoose comot ontop say the babe give him the guy gonoria afta dem kpansh each oda.

60YRS OLD VILLAGE HEAD DON ENTA POLICE PIPU HAND.

Image
One 60yrs old village head for Koje community inside Nassarawa Eggon local govt don enta police pipu hand sake of say dem see ganja, Igbo and weewee for him hand. Dem say dis old man wey be Mr Samuel Agu dey plant the ganja for him farm sef. Hmmm tori no be here ooo.

MARRIAGE GO COME WHEN TIME REACH.

Image
Nkeiru Slyvanus wey be nollywood beauriful bebe don come out tell pipu say all the amebo wey dem dey do ontop say she don marri, say na lie she neva marri. She say marriage go come when the time reach. So make una wey dey talk about her marri make una go hole una mouth.

IBINABO FIBERESIMA DON GET FIVE YEARS TO STAY FOR PRISON.

Image
 Tori wey waka come meet us dis morning be say Nollywood beauriful woman and before before Miss naija don get five years to stay inside prison sake of  say she do mistake go jam one Dr. Giwa Suraj wey die afta the accidenti wey shele for Lekki express road inside Lasgidi.

TEN DATING TIPS FOR LADIES (I GO LOVE OOOO)

Image
 Abeg make una no vex, i just see dis informate and i come feel say e go dey veri veri importankpa for all bebes, otepus, erimas, okpekes and all the totori ladies dem wey dey read tori and informate for dis my blog. Just wan tell una say make una relax, make una coolu temper, make una pechi and sabi say na we babes dey rule dis world. Dis na wetin bebes dem suppoe to dey do wen bros wan fall inside lovi lovi with you. Read am makeyou enjoy wella.  1.  Relax-  Don’t put pressure on yourself, please be relaxed smart or alluring. Be yourself, he wants to be with the real you.  2.  Dress smart-  Pick an outfit that makes you feel great, look great, and doesn’t reveal too much. Your outfit has to be appropriate for the occasion, (for example, you can’t wear heels to a picnic date).  3.  Show respect- Please ladies we know you are in charge of the night but courtesy demands you show up on time. Also be polite to the waitstaff, and give your date your undiv

CENTRAL BANK OF NAIJA FOR CALABAR DON BURN

Image
The central bank of naija wey dey calabar just burn today around 11.45 in the morning and we hear say plenty pipu burn inside the fire while plenty woundjure wella. Make Almighty God helep us for inside dis we contri.

GBOMO GBOMO KILL TWO YEARS PIKIN PUT FOR BAG

Image

SOME PIPU WEY GOD SAVE FOR LEKKI HOUSE WEY COLLAPSE

Image

MECHANIC KILL HIM FRIEND.

Image
One mechanic don kill him friend and woundjure plenty plenty human beings sake of say him friend piss for near him shop. This mechanic wey him name na Oshare for Association of maritime truck owners park wey dey berger for mile two, vex say him friend wey be Rasta go piss near one truck wey dey near him shop. As Oshare dey vex na hin Rasta come dey cool am down but Oshare come vex wooz Rasta slap. Dat one come turn to anoda gbege and Oshare come carry bottle break am take chook Rasta for neck and woundjure plenty oda pipu. As dem carry Rasta reach hospitu, him come kpai before dokintas dem go touch am sef. Hmmmmm!!!! dis world don dey tun to anoda tin ooo

GBOMO GBOMO DEM DON START AGAIN.

Image
Police pipu for Lasgidi (lagos state) don arrest one 20yrs man Mr Samuel Olabanji ontop say him thief one small boy pikin of 2yrs wey him name be Rokeeb Akinwale. According to tori dem say dis man collect Rokeeb from dia nebo small Shukura of 10yrs old back when dem dey come back from Islamiyya school on 22 of febuary. Uptill now dem neva see the 2yrs pikin but the man don confess as police catch am say dem dey tif pikin go give one Rasheed wey dey liv for Ipaja Ayobo and say dat one go buy the pikin give dem money. Make all mama and papa try shine dia eye oooo. Gbomo gbomo don full contri now                     
Image
                               POLICE ARRESTS LEKKI GARDENS MANAGER. Police pipu don finally arrest the Lekki Garden oga kpatakpata because of the five stori house wey scatter for Kushenla Road, Ikate Elegushi inside Lasgidi where 35 human beings dem kpai put Na yesterday dem go capture and arrest the man wey him name be Richard Nyong. More tori go come letta.        
Image
                        NECO - GCE NOV-DEC 2015 DON COME OUT If you be schooldent or you follow for those wey write NECO and GCE for 2015, oya make you go check your result sharparly sharparly cos result don show face. Auntie Cece dey wish una goodluck.
Image
                                        CHANGE GO SOON SHELE So many human beings dem just dey para, dey hala ontop the tinz wey dey shele for inside naija now but Baba himsef don come out talku say make all of us coolu tempa say tinz go soon betta by Gods grace
Image
                                                                             MINISTER DRIVER NO GET LICENCE My pipu i still dey surprise ooo, i no wan believe wetin i dey hear say oga Ocholi James wey be minister, say him driver no get drivers kpaali. Anyway Road Safety pipu don finally do investigeh come find out say the Minister driver too run speed and him name no dey for Road Safety pipu register of drivers dem wey get driver certifikate. Make God let dia soul rest for peace.
Image
ANNIE I DEY FEEL YOU Tubaba na one man wey sabi love and celebration woman. I just dey veri veri happi for Annie cos Tubaba dey rili show her sweet sweet lovi lovi. Carry gooo jaare Annie na you be Tubaba sweeti porero
Image
                                   ARMY GENERAL DON DIE The naija Army General wey dey lead the war against Boko Haram inside naija here don die. Major-General Yushau Mahmood Abubakar die yesterday for motor accident wey shele for Miadugri- Damaturu express road. Make Almighty Godu make him soul rest for peace Amen.
Image
                                      LAGOS SCHOOL GIRLS DON GO FOR FRESH CHECKUP We thank Chineke Godu say dem don see the three girls wey evil gbomo gbomo dem been carry waka last week monday. And we hear say dem don carry dem waka to go do test for dem. Na the pishure of the school be dis (Babington Macaulay Seminary Junior Secondary School).
Image
                                FIVE STOREY BUILDING COLLAPSE FOR LASGIDI. About six pipu don die dis morning/ afternoon after five storey building collapse for Chisco bus-stop wey dey front of Oando petrol station for Lekki phase 1 inside lagos today. NEMA pipu tanda dia since morning with Fire Service dem dey try to save human beings dem wey dey inside the house wen the five storey collapse yakata.
Image
                                               Blind Man wey thief Police pipu for lasgidi don arrest one 61yrs old blind man wey follow army robbers dem go thief tyre wey reach 20million naira. We hear say those wey dem follow thief the tyre na one  John Michael, Charles Chinonso and James Francis sef. Me I wonder how afoju go join pipu thief oo. This na dia pisure
Image
                                                                   INTERNATIONAL WOMEN'S DAY Waoooh today na the day to celebration all women all over the world gabadaya. If you be man abeg celebrate your wife today, If you be guy abeg celebrate your babe, all the brothers make una celebrate una sisters. Celebration time for Women na hin we dey today. HAPPY WOMEN'S DAY.