Posts

Showing posts from October 6, 2013

NAIJA MERECINE

Image
 My pipu time don reach wey we go stop to dey chop all this sweet sweet things wey dey spoil our body and make us dey sicki sicki all the time. Baba God don bless us wit many many betta foodu so make we dey chop am so dat our body go dey strong kpakparakpa. Today I go teach una the betta betta tinz wey CUCUMBER dey do for our body.  (1) cucumber na one vegetable wey get plenty tinz inside like vitamin B wey fit helep our body dodge from sickness.  (2) cucumber dey  helep to fight boxing with any type of cancer wey wan catch us. exampu like breast cancer, belle cancer, cancer wey dey inside blood plus including other disease dem.  (3) E get some tinz wey dey inside cucumber wey oyibo dey kol calories, fibre plus including water. dis tinz dey helep pipu wey too fat to reduce and become fyn fyn lekpa shandy and the fiber wey dey inside dey helep to digest any food wey we chop sharp sharp so dat our shit no go too dey strong and make us to waste time for inside toilet again.  (4)