Posts

Showing posts from September 29, 2013

HUSBAND DON SCARCE PLENTY NAW, HOL UR OWN WELL

Image
This world na wah. many women wey get husband take dia husband dey play football. Some no dey respect dia husband, no dey give dia husband food and even some no dey allow dia husband torchlight dem london. If you dey inside women wey dey do all dis tin, abeg make you try change sake of say dat man wey you dey do anyhow na wetin oyibo dey kol "HOT CAKE" him be to other women dem outside. Two dayz ago, women dem wey plenty reach 8,000, vex carry cane, microfone,paper, come tie wrapper, wear blouse ontop dey run go government house wey dey for ZAMFARA. As dem reach dia, na him dem come tight face like pipu wey wan shit, carry hand draw dia ear, kol dia governor come tell am say if him no find dem man wey go marry dem, say dem go carry dia load come Sidon for government house dey ansa "MRS GOVERNOR". Dem say dem don tire to dey sleep alone ontop dia bed, to dey cook food and chop alone and to dey carry blanket cover bodi wen rain dey fall. So dem come nack Mr Governor