Posts

Showing posts from November 3, 2013

Obodo Taraba talk talk man don kpai

Image
My pipu una know say holy book talk am say every thing for dis we world get him time. Time dey for person to enta dis world and time dey wen person go delete comot from dis world. Water dey rush for my eye as I carry chalk dey write dis tori. The tori wey reach our ear dis early mormor be say the ogbonge talk talk man for obodo Taraba  wey oyibo dey call speaker of the Taraba state house of assembly oga Haruna Tsokwa don kpai. We hear say him jos fall for ground and dem come rush am go hospital but him no make am at all. Other tori wey we hear be say dis talk talk man follow for pipu wey no gree make dia govano Danbaba Suntai wey go obodo oyibo go treat himself come back come Sidon for chair as govano again and say e get one time wey some jaguda boyz attack d talk talk man, kill him boy wey dey follow am waka but dem no see oga  Haruna  catch dat time. We even hear say oga Haruna Tsokwa  get heart problem before. Chaiiii, anyway make him soul sleep cooleeee for baba God house A

Our own Jim Iyke go soon Marry oooooo

Image
Contri pipu aw una dey? Una know say e don tay wey we dey hear say our own naija pikin, actor and bigga boy Jim Iyke dey waka with one Ghana yellow erima wey her name be Nadia Buhari and say Jimmy don ready to carry the bebe climb ontop altar go do "yes I do".Since we hear am, we jos Sidon dey look anya anya and dey pray make the day reach quick quick.  But as the amebo come dey waka too much sootay even fowl dem wey dey street dey tell all the birds dem the mata, na him our guy vex come nack am for him twitwi say, yes na true say him carry the otepu come naija and him family pipu gbadun the okpariso but say him no dey rush the marry me mata.  Jimmy say him and the Ghana yellow pawpaw talk about marry, say him sef don reach level wey marry dey sweet him mind but say him and Nadia Buhari no wan rush but dem dey take am sofri sofri. Jimmy boy I like your style abeggii. no rush at all bcos na jejeje person dey take lick soup wey hot.

Tubaba pikin go soon land

Image
Dikeh, Dis na the fotos wey dem take for madam Tubaba Anniemacaulay house when she gada bebes dem to join her do dat tin wey oyibo dey kol baby shower

Tubaba don score again

Image
My contri pipu, dem don talk am say anybody wey baba God bless nobody fit look am bad eye. My body jos dey sweet me sake of say our own naija pikin, the only guy wey God bless with plenty plenty things sootay any woman wey him follow play ball must catch the goal, don do the thing again. This our guy no dey slack at all, na real goal shooter him be and I wan advise all obodo naija bebes to comot eye for him body unless dem wan catch the goal wey him dey shoot anytime wey him play ball. Abeg make una clap for our own Tuface Idibia alias Tubaba. Tubaba don play ball with him fyn bebe Anniemacaulay immediately after igbeyawo, come sentence her go prison for nine months. My pipu very very soon all of us go gada for Tubaba house to do naming ceremony bcos tori wey fly enta our ear be say the wife gada oda ogbonge bebes for dia house today and dem come do dat thing wey oyibo dey call baby shower. That is to say dem dey prepare to welcome the new born baby wey our guy hide inside Annie be

RED wine and ZOBO no be the same

Image
    My contri pipu I dey wish una happy sunday oo. As I carry chalk to write this gossip, laf jos full my belle sake of say mama purity, the kajad and ogbonge babe for we naija drama house wey oyibo dey kol nollywood film industry, Mercy Johnson don vex, come tell the film marketers dem wey dey plan to give her sack letta  say shoe get size, okrika get quality, say red wine and zobo no be the same thing and cake differen from akara.. Mercy yarn all this talk when all her fans wey hear say the marketers dey plan to give her sack letta dey twitwi her ontop tweeter. Haahahahaha my pipu tru tru na good market dey sell himself. Mama Purity abegii carry goooooo