Posts

Showing posts from October 27, 2013
Image
My betta betta contri pipu, one ogbonge tori travel enta my ear today and the tori be say our own kajad bebe wey dey do film for nollywood don make the pipu wey dey incharge to dey sell film for we naija nollywood wey oyibo dey kol marketers vex sootay dem come dey plan to give am sack letta. Na one ogbonge person na him do dis amebo give us. him talk say dis ogbonge marketers for film gada for Onitsha wey dey Anambra state on Monday, come do meeting ontop aw dem go take give Mercy Johnson the sack letta sake of say since wey she come back from obodo oyibo were she go born pikin, she come dey do some things wey dey vex the film market pipu dem. We hear say the things wey Mercy dey do nah, to dey disappear comot for were dem dey shoot film wey oyibo dey kol location even after dem don pay am moni for the work, dem say she dey give dem strong strong conditions and again she dey charge too much moni. All dis tin na him make the marketers dem vex come call oda pipu wey dey dia club say