Posts

Showing posts from March 13, 2016

OONI FOR SULTAN OF SOKOTO PALACE

Image
Ooni Of Ife, Oba Adeyeye Enitan Babatunde Ogunwusi,Ojaja II and him new wife Olori Wuraola waka go visit  Sultan of Sokoto wey visit him (Oba Enitan ) for Ile-Ife before and after him Coronate. The obas dem dey ready to be rub mind ontop the one wey oyibo dey call youth empowerment, and to also make the relate wey dey between Southern and Northern Nigeria strong wella. Dis na dia pishure

WICKED WORLD

Image
Some pipu get bad mind oooo. I wonder why person go bring pikin into this world just to do the baby like dis. Na somebody throwey dis baby for Agbekolade, Agege Motor Road inside Idi-Oro area of Lagos on Friday morning.. According to wetin we hear, dem say pipu wey dey live for the area see the baby wen e don die inside gutter.

RIVERS STATE ELECTION KASALA

Image
Dis na pishure of wetin dey shele for Ward 4 Obio/Akpor  now inside Rivers state Naija,  Dem say PDP jaguda dem for Rumuodomaya go carry knife chook APC member for Ward 4 Obio/Akpor. See the pishure of the man wey dem chook.

HOUSE DON FALL AGAIN FOR MILE 12.

Image
One-building collapse today inside Mile 12 area for Lagos. The building dey for 9, Ali Close, behind Mile 12 Garage and e collapse early Saturday morning. we hear say one person don die and another woman, dey serious condition now as dem don carry am rush go hospitu.

FROM BREAD SELLER TO CELEBRITY

Image
Before before agege bread sella,  Olajumoke Orisaguna wey Baba God pick her kol, just dey shine shine anyhow. See how she dey shine inside dis gold maxi dress by womenswear brand, Salmah Guzel.

PROTEST FOR BONNY LGA OF RIVERS STATE.

Image
Tori wey fly enta our ear be say many pipu dey protest for Rivers state inside Bonny LGA because of fake result.

ASISAT OSHOALA NA ARSENAL FC BABE NOW

Image
Nigeria Super Falcons International footballer, Asisat Oshoala, don turn to Arsenal FC Ladies latest signing as she sign contract with the London-based football club.

FOLUKE DARAMOLA THE YORUBA BOOBILICIOUS BABE.

Image
Dis na the pishure of we naija Boobilicious actress Foluke Daramola and her husband. Babe i must talk true, you be Mrs Endowed.

CONGRATULOBIA TO TIMI DAKOLO

Image
Our own Popular Naija Singer, Timi Dakolo, don get Masters for  Songwriting from Berklee College of Music, wey dey USA. Congratulobia to our brother.

CONGRATULOBIA TO CHIGOZIE.

Image
One Mr Chigozie, from Ogbaku, inside Mbaitolu local government area for IMO state, don come out as the best graduate student of IMO state university inside the 7th convocation of IMO state university wey shele yesteday March 18th. Mr Chigozie, read optometry, graduate with CGP of 4.71 to become the best graduate of the university. The Imo state Governor Owelle Okorocha, give Chigozie 1 million naira, with immediately work as lecturer for the university and e give am scholarship to do him master's abroad.  Dis na pishure of Chigozie and those wey follow am celebration on dat day.

HAPPY BAIDAY MISS JENNIFER

Image
The before before Miss United Nations and ex- Queen Of Aso Centenary wey dey always travels to obodo oyibo for research or holiday gada her friends dem for Al Mamzar beach park wey dey Dubai to continue her  Baiday after she don celebration am with the one wey oyibo dey call  boat cruise on 16th March.‎ Queen Jennifer wey dey work for NAFDAC na  graduate of Microbiology from Imo State University. Dis na pishure of her baiday celebrate with her oyibo friend dem for Dubai.

OONI AND HIM OLORI WURAOLA

Image
The Ooni of Ife, Adeyeye Enitan Ogunwusi & him Olori, Wuraola Zynab Otiti follow waka today for the first time since afta dia Wedding & Thanksgiving ceremoni. The Royal husband and wife dem follow go the first matric ceremony wey shele for the Kings University, Ode-Omu, wey dey inside Osun state. See dia pishure