NAIJA MERECINE



 My pipu time don reach wey we go stop to dey chop all this sweet sweet things wey dey spoil our body and make us dey sicki sicki all the time. Baba God don bless us wit many many betta foodu so make we dey chop am so dat our body go dey strong kpakparakpa. Today I go teach una the betta betta tinz wey CUCUMBER dey do for our body.

 (1) cucumber na one vegetable wey get plenty tinz inside like vitamin B wey fit helep our body dodge from sickness.

 (2) cucumber dey  helep to fight boxing with any type of cancer wey wan catch us. exampu like breast cancer, belle cancer, cancer wey dey inside blood plus including other disease dem.

 (3) E get some tinz wey dey inside cucumber wey oyibo dey kol calories, fibre plus including water. dis tinz dey helep pipu wey too fat to reduce and become fyn fyn lekpa shandy and the fiber wey dey inside dey helep to digest any food wey we chop sharp sharp so dat our shit no go too dey strong and make us to waste time for inside toilet again.

 (4) Anoda ogbonge tin wey cucumber dey do be say e dey helep to cure disease like diabetes, high blood pressure plus including too much fat for body wey oyibo pipu dey kol cholesterol.


cucumber get plenty plenty vitamins like vitamin B1, B6, C, and D. If we carry cucumber mix wit carrot juice, e go helep us to cure dat sickness wey oyibo dey kol arthritis wey dey pain pipu for leg plus including waist. Abeg dis cucumber full market and e dey very very cheap so make una forget about biscuit, sweet, and oda sweet sweet tinz go begin buy cucumber.                                         

Comments

Popular posts from this blog

THRUST THURSDAY

BEFORE BEFORE PISHURE OF TOOKE MAKINWA