HUSBAND DON SCARCE PLENTY NAW, HOL UR OWN WELL

Click for Full Image Size

This world na wah. many women wey get husband take dia husband dey play football. Some no dey respect dia husband, no dey give dia husband food and even some no dey allow dia husband torchlight dem london. If you dey inside women wey dey do all dis tin, abeg make you try change sake of say dat man wey you dey do anyhow na wetin oyibo dey kol "HOT CAKE" him be to other women dem outside. Two dayz ago, women dem wey plenty reach 8,000, vex carry cane, microfone,paper, come tie wrapper, wear blouse ontop dey run go government house wey dey for ZAMFARA. As dem reach dia, na him dem come tight face like pipu wey wan shit, carry hand draw dia ear, kol dia governor come tell am say if him no find dem man wey go marry dem, say dem go carry dia load come Sidon for government house dey ansa "MRS GOVERNOR". Dem say dem don tire to dey sleep alone ontop dia bed, to dey cook food and chop alone and to dey carry blanket cover bodi wen rain dey fall. So dem come nack Mr Governor warning sharparly sharparly.
Out of dis women dem wey reach 8,000, 5,380 na women wey dia husband don give sack leta wey oyibo dey kol divorce, 2,200 na women wey dia husband don kpai wey oyibo dey kol widows, 1,200 na women wey no get mama abi papa again and the remaining 80 women dey inside sef.
so madamu try to make ur husband dey happy evri time, sake of say husband dey very very scarce

Comments

  1. No be small tin-oon.....all dis kind things na oyibo country we be dey' see am befor ! naw i don dey hapun 4 naija koro-koro.

    ReplyDelete

Post a Comment

Popular posts from this blog

THRUST THURSDAY

BEFORE BEFORE PISHURE OF TOOKE MAKINWA