Our own Jim Iyke go soon Marry oooooo



Contri pipu aw una dey? Una know say e don tay wey we dey hear say our own naija pikin, actor and bigga boy Jim Iyke dey waka with one Ghana yellow erima wey her name be Nadia Buhari and say Jimmy don ready to carry the bebe climb ontop altar go do "yes I do".Since we hear am, we jos Sidon dey look anya anya and dey pray make the day reach quick quick.

 But as the amebo come dey waka too much sootay even fowl dem wey dey street dey tell all the birds dem the mata, na him our guy vex come nack am for him twitwi say, yes na true say him carry the otepu come naija and him family pipu gbadun the okpariso but say him no dey rush the marry me mata.

 Jimmy say him and the Ghana yellow pawpaw talk about marry, say him sef don reach level wey marry dey sweet him mind but say him and Nadia Buhari no wan rush but dem dey take am sofri sofri. Jimmy boy I like your style abeggii. no rush at all bcos na jejeje person dey take lick soup wey hot.

Comments

Popular posts from this blog

THRUST THURSDAY

BEFORE BEFORE PISHURE OF TOOKE MAKINWA